16/08/2024
U sure say all this signing way TINUBU day do say no be sell them sell the country so ?
President Bola Tinubu and di President of Equatorial Guinea, Teodoro Mbasogo, don sign agreement to build gas pipeline for di Gulf of Guinea.
Dem Sign di agreement on Wednesday, 14 August as Tinubu go Equatorial Guinea for a three-day visit wey Mbasogo invite am to come.
Di agreement cover di legislative and regulatory measures for di gas pipeline, ownership, and also di establishment and operation of di pipeline, according to one statement by Ajuri Ngelale, Tinubu tok-tok pesin.
"We don decide say we go dey work togeda to make sure say di solution to our problems for Africa go come from within," Tinubu tok afta e sign di agreement.
Nigeria and Equatorial Guinea get good relationship. Both Goodluck Jonathan and Muhammadu Buhari bin also visit di kontri for dia time as Nigeria presidents.